
![]() |
@nwaokeleme | |
Funny Joke!! Nigerian Police Caught A Man Urinating At The Wrong Place Naija policeman arrests a man urinating at a place clearly marked “do not urinate here”. Fine: N2000. Officer: Pay now now abi make we go station? Offender: OC, I beg now. I be job applicant. I nor get work. Officer: So because you nor get work, you must doty the environment of the Federal Republic of Nigeria? You dey take your pr*ck piss anyhow for public. Abeg pay your fine. In fact, as you dey here dey argue with me, you’re wasting Federal Government’s time and that’s another offence o.” Offender: Officer, please now. God will reward you if you help me. I be job applicant.” Officer: Okay. See im face. Na so dem go dey beg. How much you go fit roger? Offender: Thank you sir. I go fit afford N500 Officer: Five hundred naira? You think say… anyway, make I mercy you in the spirit of Valentine . Bring am. Offender: Na only dis one thousand naira note dey my hand officer. Please give me 500 naira change. Officer: I no get change. Piss again. |
||
1
Replies
19
Views
1 Bookmarks
|
![]() |
@nwaokeleme | 23 hours |
what a crime
|
||


