JetBits |
! You are not logged in to JetBits. Please register or login.
* Jokehouse > Forum
eniowo
1. The Lord na my shepherd, I dey
kampe.
2. E make me sidon for where
better dey flow yanfu yanfu. And
come put me next to stream make
my body therol.
3. E panel beat my soul come spray
am white, come dey lead me dey
go through express road of
righteousness because of Hin name.
4. Walaii! If I waka pass where arm
robber, 419 and juju people boku,
come even join boko haram reach
valley of the shadow of death sef,
liver no go fail me. Your rod and
staff nko? Na so dem dey like
backbone dey comfort me.
5. You don arrange good fufu and
Amala on top table make I chop.
See bad belle people dey look waa
waa. You rub me for head with
vaseline intensive lotion. My cup
come be like River Niger dey
troway dey go.
6. True true, better life and mercy
go dey follow me till I quench. And
I go tanda for God house... lai lai I
no go comot for wia better dey.
God Almighty, Na you biko!
AMEN!
16 Replies 96 Views 2 Bookmarks
Page #: 1/2
> »
> »
topics posts
Page#

* Jokehouse Forum
fav Bookmarks

* Jokehouse